Yanga FM 89.9

Presented by Suo, MC Advice

Yanga Sports

Yanga Sports

Yanga Sports by Presented by Suo, MC Advice


Info and episodes

Eucharia Anunobi Don Vex Say People Just Dey Enter Her DM With Nonsense “Hi” and “Hello Beautiful”

Written by on April 16, 2025

Eucharia Anunobi Don Vex Say People Just Dey Enter Her DM With Nonsense “Hi” and “Hello Beautiful”

Nollywood mama and evangelist Eucharia Anunobi don carry her matter go IG, dey para for people wey dey enter her DM anyhow, like say na play ground.

For the video wey she drop, she vex say people too dey dull for this life. Instead make dem talk wetin carry dem come, dem go just dey drop dry “hi”, “hello”, or “hello beauty” like say person get time.

“I no understand o. Wetin be all this? You go just enter my DM drop ‘hi’? ‘Hello beauty’? You think say na joke we dey here? You no get better thing to yarn?”

Eucharia Anunobi Don Vex Say People Just Dey Enter Her DM With Nonsense "Hi" and "Hello Beautiful"

Eucharia Anunobi Don Vex Say People Just Dey Enter Her DM With Nonsense “Hi” and “Hello Beautiful”

She talk am with serious voice, say time don go, everybody dey chase money, dey hustle, and person go still dey waste time dey do “hi and hello” for DM.

“So na make we dey yarn anyhow? You go say ‘hey’, I go reply ‘hello’, next na ‘how you dey’. Abeg, bros/sis, talk wetin carry you come abeg! No time for small talk. Life no be whatsapp chat o!”

She say if you wan run matter, whether na business, friendship, or even to toast person, make you talk am straight — no dey beat around bush.

“Omo, talk your mind. If you wan shoot your shot, shoot am well. Talk your reason. No dey carry corner corner come person DM. Everybody get wahala, no dey waste my time!”

Last last, she throw one hot one:

“You no sabi say life na about grabbing chance? Na why common sense no dey common for some people.”


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist