Yanga FM 89.9

Fireboy DML say Ghana beta pass Nigeria

Written by on April 14, 2025

Fireboy DML say Ghana beta pass Nigeria

Naija singer Fireboy DML don drop him mind say Ghana Black Stars dey play better football pass Nigeria Super Eagles right now.

Fireboy DML say Ghana beta pass Nigeria

Fireboy DML say Ghana beta pass Nigeria

Fireboy yarn say even though Nigeria get more talented players, Ghana sabi play better as team.

“Right now, Ghana na better team. Individually, we Nigerians beta pass dem. But as team, Ghana dey more solid,” he talk.

Fireboy come add say Nigeria never sabi mix all di talents wey we get to build correct team.

“We get talent, but we never fit use am well. We never gel as team.”

Him also mention say Ghana midfield na major problem for Nigeria, especially as Thomas Partey dey run things steady.

“Make we talk true, we no get midfield like Ghana. Partey dey carry Ghana for back. You see wetin he do against Real Madrid? We no get person wey fit do that.”

This tori dey drop as people dey prepare for another Nigeria vs Ghana football showdown for Unity Cup wey go happen for London next month.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Current track

Title

Artist