Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

Tobi Makinde: “Meeting Funke Was A Miracle

Written by on July 22, 2026

Tobi Makinde Yarn How E First Meet Funke Akindele and Na Miracle E call am 

Actor and producer Tobi Makinde don spill new gist for YangaFm  on top WhatsUp Naija show Wey  get people talking. The man take listeners back memory lane, yarning how e first cross path with veteran actress Funke Akindele  and trust Naija story, e no lack drama.

The UNILAG Gate Wey No Gree Open

According to wetin Tobi tell the gist , everything start back then when e still dey UNILAG. Funke Akindele and her crew been dey shoot Return of Jenifa for campus that period. Naso young Tobi wan enter see wetin dey happen, security no gree. The place don already full  no space, no entry, straight up “abeg comot for gate” situation. Tobi say na so e just come see Funke Akindele from far no handshake no proper introduction, just vibes and admiration from outside the ropes.

Fast Forward: Masters Degree And A Friend’s Tip-Off

Life get correct way e dey arrange things sometimes. Tobi later begin im Master’s degree program for 2015, and na there one friend come drop am gist say audition dey happen. That no be just any audition, na Funke Akindele own movie, Industreet.

Tobi Makinde Funke

Tobi Makinde at YangaFm

Now, audition no be new territory for Tobi. E don already dey go audition after audition, back to back, and nobody dey pick am. Anybody wey don try job hunting sabi how that kind rejection fit knack person confidence  but Tobi no gree carry last.

From Rejection To Recognition

E show up for the Industreet audition, and this time, luck finally smile. Dem pick am. Just like that, the same woman wey security no gree make am see face-to-face for UNILAG years back, na she come give am im first real work.

Tobi describe the whole turn of events as nothing short of a miracle  and honestly, who go blame am? From standing outside a closed gate as an eager student to landing inside Funke Akindele’s own production. Na testimony material be that one.

The Takeaway

Tobi Makinde story dey remind us say doors wey shut today fit open tomorrow. Plus sometimes even wider pass wetin you expect. E also show say persistence, even after plenty rejection, fit still connect you to the exact opportunity wey go change your story.


Continue reading

Current track

Title

Artist