Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

How Throat Surgery Nearly Silenced Tekno

Written by on July 10, 2026

How Tekno Throat Wahala Cost Am One Million Dollars in Refund Plus Career Pause 

Tekno don see pepper, but this one almost finish am. The Afrobeats star just open up on one of the roughest period for im career wey be the throat swelling wey almost carry im voice comot for good.

When The Voice Almost Quench

Between 2017 and 2019, exactly the time Tekno dey shine well well, throat wahala catch am. Swelling enter, and just like that, to sing become mission impossible. No stage, no studio, no show. For person wey im whole hustle na to sing, that one no be small thing this na career wey pause suddenly.

Tekno no hide face for the matter. E call am one of the hardest time for im life, because e happen exactly when e dey top form. Timing na everything  and im own timing choke.

The One Million Dollar Refund Wey No Sweet

Here  the real gbege start . Tekno had to return over one million dollars for booking fees. Imagine you sign deal, plan show, then your body come tell you say “no be today.” E no be small loss. Na the kain setback wey go test whether you still love the job after all the money don go.

Tekno throat surgery

ALHAJI TEKNO

Chasing Cure Round The World

Nigeria no fit give am wetin e need, so Tekno start to dey shop  for doctor, no be for cloth. E waka reach different countries dey find better specialist, until e land for New York, where surgery finally solve wetin worry no fit solve for months.

Say wetin you want about “japa,” but sometimes na so e be  you go find person wey fit save your voice, literally.

Tekno talk say the whole matter change how e dey see life. To lose the very tool wey build your name go always force person to reflect. E come out different side, and to still dey here dey make music today talk plenty.

 Tekno No dey Alone

Tekno join long list of Nigerian stars wey health wahala don shape their career quietly for background. E dey remind us say even the biggest voices for industry na ordinary humans, throat and all.

E don return, e don talk am, and the money loss no dey pain reach before  since the story get happy ending.


Continue reading

Current track

Title

Artist