Yanga FM 89.9

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija

What’s Up Naija


Info and episodes

92nd Minute Disaster Ends South Africa’s Run

Written by on June 29, 2026

Bafana Bafana World Cup Dream Die For 92nd Minute as Canada Break South Africa Heart

South Africa nearly write history o. Nearly. But football no dey gree carry last for anybody, e go just humble you anyhow anyhow. Bafana Bafana comot from 2026 FIFA World Cup on Sunday after Canada beat dem 1-0 for one Round of 32 match wey make everybody dey bite finger nail.

How The Heartbreak Happen

For 91 minutes, South Africa dey play like dem go pull off one of the biggest defensive masterclass for this World Cup.  Dem just dey sit down well well for back, dem frustrate Canada attack, and e be like dem just dey wait for extra time. Goalkeeper Ronwen Williams dey waste time anyhow for goal kick, you fit see say Bafana want penalty, dem no want wahala.

2026 World Cup Round of 32

World Cup Heartbreak

Time No Gree Wait For Dem

 As Canada captain, Stephen Eustáquio, carry ball outside the box. Naso himjust hammer am one touch, one shot, ball enter bottom corner. Los Angeles burst! South Africa bench fit only dey watch like film.

After that goal, South Africa throway everything dem still get, but the damage already do. Clock done finish for Bafana fairytale, Canada hold the win make dem reach Round of 16 for the very first time for dem history.

Tournament Wey Person No Go Forget

No mistake o  South Africa World Cup story na one wey go enter history book. To even reach knockout stage na big flex already for African football, and Bafana Bafana dey leave North America with dem head high, even though dem heart don crack small. Canada side, dem go face either Netherlands or Morocco on July 4 for Houston, dem want quarterfinal spot. Coach Jesse Marsch don already dey call him players “Canadian heroes” after the final whistle.

For South Africa, e pain well well to fall this late, this close. But champion no be only trophy dey make person, sometimes, just to enter the dance fit count as win too. Bafana Bafana, e go better next time.


Reader's opinions

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *



Continue reading

Current track

Title

Artist