Menu
Peter Okoye Don Vex, Testify Against Jude for EFCC Case
Written by YangaEditor1 on April 16, 2025
Peter Okoye Don Vex, Testify Against Jude for EFCC Case
Singer Peter Okoye, one half of the music duo wey dem no dey together again — P-Square — don come out blast him family after he testify against him elder brother, Jude Okoye, wey dey face money laundering charges.
Jude and him company, Northside Music Limited, dey face serious wahala as EFCC carry dem go court say dem launder money — ₦1.38 billion, $1 million, and £34,537.59.
Peter yarn for him Instagram Story on Tuesday say him mental health dey very important pass any other thing. E come ask wetin be the real meaning of “family”.
According to am, real family suppose stand for love, loyalty and trust, no be manipulation, betrayal or thief thief.
Peter talk say the kind toxic things wey dey happen for inside family dey tire person and e don disgraceful. Him no go ever again put him peace of mind for risk because of anybody.
wetin him talk:
“No let ‘family’ be the reason wey you dey suffer in silence. Me I do am — for over 20 years plus. And e almost ruin my life,” he talk.
“But now I wise – love no dey manipulate, loyalty no dey betray, and family no suppose dey thief from you. Any ‘family’ wey dey thief from you and dey break you down, no be family be that.”
He com still add:
“Real family no go drain you, no go shame you, no go treat you like say you no matter or turn blind eye to your pain. My sanity na everything. My mental health na priority. If e go affect my mental health, e don cost pass wetin I fit pay.”