Laide Bakare Yab Eniola Badmus for Public
Written by YangaEditor1 on April 15, 2025
Laide Bakare Yab Eniola Badmus for Public
Wahala don burst again for Nollywood as actress Laide Bakare don open fire for Instagram, drag her colleague Eniola Badmus over wetin she talk say be insult wey happen after she post one photo online.

Old Padi Turn Enemy? Laide Bakare Yab Eniola Badmus for Public
For the hot clapback wey she drop, Laide no hold anything back as she remind Eniola say na she first give her big chance for film industry when nobody wan work with her because of how she look and her body size.
She talk say:
“@eniola_badmus na me give you your first big movie role when nobody gree near you because dem dey yab your ugly face and fat body. I use my own money support you, and now wetin you fit pay me back na to call me animal? Na God go judge you, insha Allah.”
This gbas gbos come just a few days after both of dem nearly jam body for Owambe Thieves movie premiere wey happen April 13, 2025, for Filmhouse Circle Mall, Jakande.
People wey dey the event talk say Eniola no smile at all when she see Laide dey dance. For one video wey dey fly for social media, Eniola even talk for Yoruba say: “No video us together, we no be friends,” as Laide dey waka come her side.
The beef don cause serious gbalaga online, as fans and industry people dey talk say dem no believe say the two actresses wey dem see as friends go drag themselves like this for public.
As e be so, Eniola Badmus never talk anything officially about the matter.
This gbas gbos just join the long list of celebrity wahala wey dey shake Nollywood recently — and e don make people dey wonder wetin dey really happen behind camera for the industry.