“Fireboy DML: Why I Dey Hide My Tattoos From My Papa”
Written by YangaEditor1 on April 14, 2025
“Fireboy DML: Why I Dey Hide My Tattoos From My Papa”
Afrobeats superstar, Adedamola Adefolahan, wey everybody sabi as Fireboy DML, don open up about one deep personal matter — how him papa no happy say him get tattoos.

“Fireboy DML: Why I Dey Hide My Tattoos From My Papa”
Di 29-year-old singer talk say di tattoos wey him draw really pain him papa well well, and up till now, e never still accept am.
“One thing wey fit break my papa heart? I think say I don already do am — na my tattoos,” Fireboy yarn.
“Anytime wey he dey come visit me, na jalabiya I dey always wear, make everything cover. Because anytime he see those tattoos, e dey really break am.”
Even though him papa no get wahala with him ear piercings, Fireboy talk say tattoo matter na serious one wey still dey cause small gbege between both of them.
“My papa no too mind my piercing, but these tattoos? That one na no-go area. He go never forgive me for these ones.”
But Fireboy still stand by his choice. Him talk say, even if he no be artist, even if he be banker or do any other job, he go still draw tattoos because e mean something deep to am.
“Even if say I be banker, I for still get tattoos. No be because I be artist. Na just how I be. I dey see am as art.”
According to Fireboy, tattoos na form of expression for am. E talk say sometimes e go waka shirtless or just wear singlet, but still look like say he don dress well because of the body art.
“Sometimes I fit no wear shirt, or just singlet, and I go still get presence. Na wetin tattoos dey do for me be that.”
Di Peru hitmaker don always stand out with him unique style and vibe. With this talk, Fireboy don show say him tattoos no just be fashion — dem dey represent who he be, even though e dey affect how him papa dey see am.