Eedris Abdulkareem Talk Say “Tell Your Papa” No Be Beef for Seyi Tinubu
Written by YangaEditor1 on April 14, 2025
Eedris Abdulkareem Talk Say “Tell Your Papa” No Be Beef for Seyi Tinubu
Naija rapper Eedris Abdulkareem don clear the air say him new jam, “Tell Your Papa,” no be diss track for Seyi Tinubu, wey be pikin of Presido Bola Ahmed Tinubu, but na direct reply to wetin Seyi yan publicly about him papa.

Eedris Abdulkareem Talk Say “Tell Your Papa” No Be Beef for Seyi Tinubu
For March 2025 for one speech wey happun for Yola, Adamawa State, Seyi talk say him papa na the “best president Nigeria don ever get.” Eedris talk say na dat yarn trigger the song, as e dey try show say wetin Seyi talk no match the suffer wey full ground for Naija.
“I no dey attack Seyi Tinubu o. Na just reply I dey give for wetin him talk,” Eedris yan. “If him no talk am, I no go even do the song. Wetin Nigerian youths need no be palliative—na better light, work, security, and good environment to survive.”
NBC Ban “Tell Your Papa”; Wole Soyinka Vex Say Na Censorship
As the song drop, National Broadcasting Commission (NBC) quick ban am from radio and TV, say the song no dey “appropriate.” This action don cause gbege for everywhere, as people begin vex say dem wan use am shut down free speech.
Prof. Wole Soyinka, wey be Nobel Laureate, no even take am easy—him talk say the ban na “dangerous waka back to censorship”, and e no good for democracy at all. Since then, social media don scatter with support for Eedris, as people dey para say dem no wan make anybody talk truth again.
“Nigeria Jagajaga” Still Dey Relevant After 24 Years
Eedris still remind us about him old jam “Nigeria Jagajaga” wey e drop for 2001. Him talk say e pain am say even after 24 years, Naija still dey face same wahala like corruption, insecurity, and bad governance.
“I no believe say after 24 years of Nigeria Jagajaga, the song go still make sense like this,” he talk. “E just show say Naija never move forward like we suppose don do since.”