Adekunle Gold Use Joeboy Catch Cruise After E Lose N3 Million Bet
Written by YangaEditor1 on April 11, 2025
Adekunle Gold Use Joeboy Catch Cruise After E Lose N3 Million Bet
Naija singer Adekunle Gold no fit hold laugh as him drag him guy Joeboy for social media after the guy lose N3 million bet.
Wetin happen be say Real Madrid chop 3-0 beating from Arsenal for UEFA Champions League quarter-final on Tuesday night. Joeboy bin bet say Madrid go win, and if e happen, he for cash out N10.3 million. But Arsenal finish work for Emirates—dem beat Madrid proper proper.
Before the match, Joeboy even tweet say:
“Cashing out on Arsenal tears tonight!”
But na him own tears end the night as the bet cut clean!
After the match, Adekunle Gold post Joeboy’s tweet with cruise reply:
“Lmao. You don go blow stream money. Next time face your club.”
Cruise just full everywhere as fans join laugh for comment section.